One member of di Senior Advocate of Nigeria wey deh for Lekki wey e name na Ebun-olu Adegboruwa don condemn di action of OGA Presido to stop movement of people, sake say e no get right to stop people movement just like that plus say e no e no get di backing of di National Assembly as dat one dey very very Illegal.

E kon talk say , Oga Presido suppose consult di representative of di state before e gho declare anything, plus say na only di Govonor for any state thru di House of Assembly get right to make any declaration as e take concern dat state.
Finally, e beg Oga Presido to change wetin e talk and dey sure say e carry di state and their representatives along so dat anything dey do go dey Legal…
this tori na amara write ham for pidgin radio